ABEG, MAKE WE NO VOTE WITH ANGER; TRY MAKE YOU UNDERSTAND WETIN DE HAPPEN FOR NAIJA ECONOMY_

 

Na me - ya bros - Hon (Amb) Stanford Arinze Nwokedi, JP de yarn.




My brothers and sisters - Ndị Igbo ibe m, make we talk true talk, for simple language wey everybody go understand. No be grammar we come write here. Na why things hard we come to explain, and why if we vote because of anger, we go suffer pass before. Na make we for reason am well-well be my koko.



Imagine a man wey dey sick - very sick, but e no know. E still dey waka, e still dey laugh, but inside im body, im heart don weak, im blood don low. Na so Nigeria be before May 2023. For outside, petrol be ₦197, dollar be ₦460 for government paper, everything look cheap. But inside, Nigeria don die finish. Government dey earn ₦100, e dey use ₦97 take pay debt. Only ₦3 remain for salary, for road, for school, for hospital. How country go survive like that? About 27 States no fit pay common salary.


Dem tell us say fuel subsidy na help for poor man. Make we check am well naa.


Government dey buy petrol for abroad for high price, come sell am for Nigeria for low price. Who de pay the difference? Na Government. Where e get the money? Na borrow e borrow am. For 2022 alone, government borrow ₦4.39 trillion take pay that difference, money wey pass money for education, health and defence join together for our budget o.



But who chop am? If you get car, you chop am well well. If you get big generator, you chop am well well. If you na poor woman wey dey trek go market, if you dey cook with firewood, you no chop anything. World Bank talk am say 80% of the subsidy go to rich people, less than 3% go to poor people. So Nigeria dey borrow money take help rich man, come dey call am help for poor man. Na lie be that. And shebi you know say our border dey open like basket. The same subsidised petrol dem dey smuggle go Cameroon, Chad, Togo and other African countries.



Second sickness na dollar own. Before, government get two prices for dollar. For government office and banks, dollar na ₦460. For street - Ama Hausa, dollar na ₦750 or ₦800. Who government dey give the ₦460 dollar? No be you, no be me, no be market woman. Na big men wey know somebody. Dem go collect am for ₦460, go sell am for street for ₦750, pocket the profit. Dem no farm, dem no produce anything, dem just dey chop free money. Factory wey need dollar no fit get. Investor run comot, because e see say na lie lie system. Na so fuel subsidy and forex subsidy be, two barrels of gun wey dey shoot our economy from two sides. One dey drain money, one dey drain trust.



Now make we ask the big question - what if Tinubu no do anything for May 29, 2023? Nigeria for go bankrupt. Bankruptcy for country no mean say government go lock shop. E mean say naira go turn to toilet paper wey no get value. Go ask Venezuela people. For Venezuela, people dey carry wheelbarrow of money go market to buy bread. Teacher become beggar. Doctor run comot country. Mama dey look pikin dey cry for hunger, no be because food no dey, but because money for hand no fit buy anything. Na there we dey go.





 Tinubu talk am for Uyo. If we no take decision that day, we for dey use wheelbarrow carry naira, because naira for don become useless. Na why e take decision for Day One. No be because e wicked. Na because if e wait small, e go too late. Jonathan try am for 2012, dem force am to go back. Buhari promise am, e keep am for 8 years, dey borrow to pay am. Tinubu na the only one wey get mind to do am.



I know say e pain us. Petrol don go up, transport don go up, garri don go up, rice don go up. E pain me too. I get five children. E no easy. But the pain na because the sickness don tey. If person get boil wey don rotten inside for 40 years, when doctor wan cut am, e go pain. But if doctor no cut am, the person go die. Na so be this reform. The pain na the cure dey work, no be the sickness. Opposition want make we stop the surgery for middle, make we go back to borrowing, go back to subsidy, go back to cheap dollar for big men. Dem dey call that one compassion. Na lie. Na wickedness be that.



Make we no lie, things don dey change small small. Before, 27 governors no fit pay salary. Today, no governor fit talk say e no fit pay salary. Before, for every ₦100 government earn, ₦97 go debt. Today, na about ₦45 dey go debt. Before, dollar for government office and dollar for Ama Hausa far like Lagos to Kano. Today, dem almost be the same, that mean the thieves wey dey chop free dollar don lose their market. Our reserve don rise pass $50 billion. Inflation wey go pass 30% don come down to about 14.6%. Minimum wage don double to ₦70,000. Students dey get loan to go school. E never reach your pot of soup, I agree. But if we no do this reform, pot no go dey at all. Country no go dey at all.



My people, anger na bad adviser. If you dey hungry and you use anger take vote, tomorrow you go still dey hungry, but now the country wey dem dey heal go start to bleed again. The opposition no get another plan. Dem only dey tell you make you vex. Dem no tell you say if dem bring back subsidy, your pikin go inherit debt wey e no fit pay. The medicine wey dey save us, dem want make we call am the sickness. No make that mistake.



Wetin Tinubu do na altruistic measure. E do am no be for im own good, but for our good. E know say people go curse am for small time, but e do am because if e no do am, our children go suffer pass us. Na like mother wey dey give pikin bitter medicine. Pikin go cry, pikin go say mama wicked. But mama know say if pikin no drink am, pikin go die. Na so be this reform. E bitter now, but e go sweet later, when our refineries work, when our farms produce, when our naira get value again.



We just survive precipice by whiskers. Make we persevere small more. Make we no fall back inside pit because we dey vex. Make we no vote in anger. Make we no vote because  we de hungry. Vote with ya head. No vote from ya belle. Vote for the future of our children.


 Nigeria was saved from collapse. Now Nigeria must be saved from hardship. This hardship go soon  pass.

Post a Comment

0 Comments